Brymo – Illusions Lyrics

Brymo – Illusions Lyrics
Illusions
Brymo
    Lyrics copied!
    Illusions Album Art
    "Illusions." - Brymo

    Album: Theta
    Track No: 01

    You carry boyi go yonder
    You say he no go oh
    Slavers boku round town
    Hin brother tell am oh
    Stand for your ground
    Make you no hurry follow go
    Them dey sell people troway
    My brother no go oh
    The people them wey go river never return oh
    Dem say na mami water
    Carry everybody go oh
    For full moon, Papa go farm he never return oh
    Them say na the forest carry am swallow oh
    Listen boyi, life no balance at all oh
    You go place you no know
    You no go return oh
    Boyi feeling true
    Him heart dey beat for the road oh
    Him fate na to follow dem
    Follow journey go
    Ah ah ah
    Wetin I think I become ah
    Ah ah ah
    Na illusion dem dey sell you so
    Boyi look forth, him look out
    No other place to go oh
    He carry him few belongings
    Reluctantly follow go
    For this life we dey
    The things you do you know oh
    E better to go reach the place find how e dey oh
    I talk am, I shout am boyi still dey travel go
    Na destiny dey push man where him dey go ah
    He try am, he fight am
    Urge stronge no be small
    The tori e dey the place
    Where him dey go ah
    Ah ah ahhhh
    Na wetin I think I become
    Ah ah ahhhh
    Na illusion dem dey promise you so
    Oga master no wan know how
    Value pig fat pass people oh
    He say dem be property
    With him dog dem equal oh
    Boyi clean gun, he shave beard
    Oga trust no other
    He for adopt boyi, but him people hala
    That night boyi take razor he shave am proper
    The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
    Poison for soup, for family and the guards dem
    He slash master throat too from ear to ear ah
    Ah ah ahhhh
    Boyi na most wanted for strange country ah
    Ah ah ah
    He dey gather soldiers ah
    From plantations he dey break boys free
    Ehn ehn
    My people
    The main reason we gather here today
    Na him concern us now
    Na there we dey go next
    Ah today on behalf of the people of the city and the township
    The entire tribe and our very very race
    We go unveil this statue of boyi
    We go give our honorable personality himself
    The scissors to use cut the ribbon
    For service to humanity
    And to race and eh we salute you sir
    We salute you well well
    Because you really touch our lives
    You don change our lives
    From generation to generation to come
    Nothing go ever remain the same for us
    Yes, this statue na the honor of your greatness and service
    Thank you

    Writer(s): Ezenwa Ogbonna, Olawale Olofooro.

    All lyrical content displayed on this website is the intellectual property of its respective copyright holders. No ownership is implied, and no copyright infringement is intended.

    Get the Latest Lyrics Updates!

    Subscribe now and never miss a new song lyric update.

    Failed to load audio, please try again later.
    Failed to load song data.
    Invalid email address entered!
    Enter your suggestion!
    Thanks for your suggestion!
    Link copied
    Stop & exit Playlist

    Suggest a Lyrics Edit

    Stop Song
    Rhyto-Artwork

    Illusions

    Rhyto
    × Add Rhyto to your Home Screen!