Falz – How Far Lyrics (feat. Sir Dauda)

Falz – How Far Lyrics (feat. Sir Dauda)
How Far
Falz (feat. Sir Dauda)
    Lyrics copied!
    How Far Album Art
    "How Far." - Falz (feat. Sir Dauda)

    Album: Wazup Guy: The Album (Deluxe Edition)
    Track No: 08

    Someone told me long ago say life go better
    Still we dey under the weather
    Someone tell me how far?

    And since 1960, we don dey waka
    And even now sef we still dey the matter
    How far?
    How far?
    I pray tell me how far?

    Ah, why?
    Why life for here just dey somehow?
    Why some people no fit get food when dem wan chow?
    Yet some people fit land jets for them compound, ha
    Why that money no fit come round?
    So when I need me sef I'll have some, on ground

    Why children no fit go school, why dem dey unsound?
    Why dem no fit fulfill their dreams as dem for like to?
    And this rate of poverty lo ṣí high jú

    (How far?)

    Ha, dem say oil dey, o yẹ ká lowó gáan
    But our leaders dem wise pass Solomon
    Dem mismanage everything, wọn kàn dá'lú rú
    Hey, giant of Africa, àwọn gàan ti wá ṣúbú

    Poor man dey hustle, he dey find work
    But the elites dey okay, dem dey buy stock
    All man see, me sef no be say I shock
    But I get questions, I need follow some guys talk

    Someone told me long ago say life go better
    Still we dey under the weather
    Someone tell me how far?

    And since 1960, we don dey waka
    And even now sef we still dey the matter
    How far?
    Una tell me, how far?
    Abeg tell me how far?

    Someone explain to me, abeg, 'cause I no know how
    To dey blow up towns don dey in vogue now
    Abeg gimme the gist, gimme the low down
    Shey na like this things suppose go down?

    She don turn 53 but look am head to toe
    Wetin she don achieve, wetin she get to show?
    We still no get light, we still dey use gen
    We still need more schools for the children

    (How far?)

    Area boys plenty, dem no see job
    Why dem no go carry gun and begin rob?
    Meanwhile Naija police, dem still dey beg for pay
    Dem need deliverance, carry dem come pray

    We don dey wait make things change but no show
    We no progress, be like we dey for go slow
    I for no talk like this if bomb no blow
    If people no fight, if blood no flow

    Someone told me long ago say life go better
    Still we dey under the weather
    Someone tell me how far?

    And since 1960, we don dey waka
    And even now sef we still dey the matter
    How far?
    Una tell me, how far?
    Abeg tell me how far?

    Crystal clear, everybody dey see
    My people gbádúrà, my people réti
    Some people don go, nítorí t'èmi and nítorí ti e, ah
    So if fire no dey, walahi ko le si a fame

    Mo ni crystal clear, everybody dey see
    My people gbádúrà, my people réti
    Some people don give up, sef
    'Cause when we dey primary one, dem say make we lead and not to follow
    Say when we grow up, we go be leaders of tomorrow

    Shey tomorrow go come?
    Shey dem go leave us, when?
    'Cause the same set of people wey dey lead us then
    Are still the same damn people wey dey lead us, mehn!

    Dem say we go write the future, dem no give us pen
    Give it up for VIPs, dem be our problem
    Vagabonds in power, as Fela call them
    But change go come, yeah, right, I know
    Dem say dem dey lead but dem just dey do us wayo

    Hunger dey waya guys for here, sotey their eyes red
    Hunger show this guy pepper, sotey the guy shed
    O ṣhi wa lojú títí all day, dey find bread
    Na only hustle he know, na struggle dey inside him head

    Guys try hard, dem dey hold tight for here
    But condition's too harsh, e cold pass oye

    Someone told me long ago say life go better
    Still we dey under the weather
    Someone tell me how far?

    And since 1960, we don dey waka
    And even now sef we still dey the matter
    How far?
    Una tell me, how far?
    Abeg tell me how far?

    Writer(s): Falz, Sir Dauda.

    All lyrical content displayed on this website is the intellectual property of its respective copyright holders. No ownership is implied, and no copyright infringement is intended.

    Get the Latest Lyrics Updates!

    Subscribe now and never miss a new song lyric update.

    Failed to load audio, please try again later.
    Failed to load song data.
    Invalid email address entered!
    Enter your suggestion!
    Thanks for your suggestion!
    Link copied
    Stop & exit Playlist

    Suggest a Lyrics Edit

    Stop Song
    Rhyto-Artwork

    How Far

    Rhyto
    × Add Rhyto to your Home Screen!