Falz – Story Time Lyrics

Falz – Story Time Lyrics
Story Time
Falz
    Lyrics copied!
    Story Time Album Art
    "Story Time." - Falz

    Album: The Feast
    Track No: 12

    See you for leave me make I do am acappella
    Who wan stop my pena I go do am that panenka
    Oya check am
    Omo Folarin the born skiller
    Them don know say the boy go be great Okunrin meta

    Them say Lion no dey born goat
    Lord knows, this one go still fulfill hin purpose
    One day
    But now I'm quiet in the motto
    My Maale don dey boil o
    I know that I'm in trouble

    Me no just like school really
    I fuck up I know say she go discipline me
    Out of 54 I carry 53
    My Maale cry pieces
    I no just like the feeling

    But the young shall grow
    Before una know, I get double promotion sha
    Stop am o, no be say I no know book
    Na somеthing man go go through
    Food wey dey sweet dey slow cook

    I prеfer playing boju boju
    Cute dribbles, word puzzles to Sudoku
    Arithmetic my nemesis I have no clue
    If e don dey wan resemble science me I no do
    Oga shebi I told you. I dey ball!
    I'm like JayJay Okocha, when I dribble men dey fall
    Tí n bá múra mo le replay USA 94
    I get the talent and the drive, I go make am e sure
    If I just try to keep am up, balance with my report card

    Slow down! Come back
    Yoruba Parent no too dey raise footballer
    You go go university, you go read Lawyer
    You go be like your father, you no fit to dodge am

    I con dey reason am say okay this football P
    Omo I go really like play am o
    Like professionally bro. For real
    But school though, do I really have to go?
    Can I just dodge the P

    I no dodge am o. I don dey big up
    I dey feel say all my days of adolescence e don come and go
    Voice getting deeper, couldn't come any quicker
    That thing wey I start I go finish, I no be quitter

    This thing I dey do like small hobby e don dey ginger
    When I dey SS1, na there I start dey perform
    Shout out to my boy teddy, Òun ló jé kin bèèrè gaan
    We Dey for Dorm, we Dey hear tribe's men plenty nonsense
    We listen listen till we know rap was what we wanted
    How I take dey run am, walahi kò sómo béè
    School boys wan play for variety show call your friends
    I enter Uni 16
    This United Kingdom e too cold for pesin pikin
    New schedule no be routine
    Balancing no time I find my circle
    This place no be my father land I for try dey careful
    Rap wey I dey do like play, I for up the level
    Enter studio proper
    Kò séni tó mòla
    I fit go throw double 6, life na Ludo run am
    Na then Aboki call me say my talent yapa
    Make we start our own label, kaa le plan eh dada

    Baba buzz me on some bro, let's let's try and be business smart with this P
    Look. This is how them Jay Z started bro
    They started in one room, they formed a company and...
    I was like bro, which one be all this...
    Me I just wan make music but, no yawa, let's go

    We plan am well, We start afresh
    I start dey do show here and there, money no matter first
    I enter law school for Abuja then, my ex girl we broke up since my 2nd year
    But now I no dey find distraction
    I'm just tryna make it in this game I need a platform
    Don't wanna break your heart so baby I go beg your pardon
    Mi ò lè fún omo ní many promise, kin wá fí lè sá lor
    Don't wanna take on what I know that I can't really fathom
    You no happy with my decision then cry me a gallon
    I waka waka, I go TV, I go radio drop my CD
    Shakara the mixtape na the first time wey them go feel me
    And then cool party, 1,2,3
    All this time I no let lecturers to dey confuse me

    2012 I was called to bar, before I turned 22
    I no need to reason many before I stand for the truth
    It's the only way I know
    What I saw my father do
    What my mama says is right
    What seems rational too

    2013 I met Femi soro
    My guy say He see the dream, he go vibe for the culture
    And all three musketeers gaan ló wà Lonà
    The day baba God go say him must to show him color
    If we no die for road, baba nothing go kill us
    In all versions of this story, no one where we give up
    Tryna convince our folks that the hustle is serious
    Then we hit the first million

    1 million naira... eh God
    They say there's a private wedding
    It's in Abuja
    It's happening this weekend
    Bro I'm there already

    2014 I drop my first album now you know I'm a wazzup guy
    Same time I dey catch banter
    With Foladele Folakemi I no plan that
    Talk one small tin, e cause big laughter
    I Talk another one, everybody scatter
    Sometin wey dey body since, na this one you dey chop?
    I go taku for these streets
    Now I don dey be like jester
    I dey worry for secret
    But by 2015, omo stories that touch was a hit
    Shout out Sesan Salami
    Omo le la korí sí
    When I met Simi na these three people committee, wey give birth to сhemistry

    Are you guys dating?
    What's going on here
    This this looks like there's some romance brewing
    Can you guys tell us what's...?

    I start dey write my film story for Jenifa's Diary
    This year mo sáré gba AMVCA kan dání
    Same year, I win BET, niggas Dey beef me
    Abínibí yàtò si ability

    2017, I dropped 27 just before I turned 27

    2018, I just wan freestyle about the state of the nation, this is Nigeria

    2019, they tagged me stubborn, kínni mo she, mo sáré drop moral instruction

    That one no be just title, my mic e turn rifle
    I hala but, I hala boj, make e no cause fight too
    Omó ń gbóná feli feli, e mó pe kò sénikéni
    Nothing wey for fit prepare me, lockdown 2020

    Corona virus hold the world
    But that one sef no mean say Bop Daddy no go rock
    But by the time we go return, everything don change from that wey we know before
    October pulled us out to the streets, threw me the mantle
    Showed me if we really all came together, this what we can do
    RIP to those that we lost, broke me to shambles
    I know say ups go still meet down for where them trample

    2022 brought bad, syphilis slept on
    But them go still come back
    2023, was surgey, na the same ball I dey play, but I'm now 33
    2024, I dropped a treat, quick 6 track and this the one that comes before the feast
    Red carpet fresh, kill em with the swag when I step out in that mad on som'
    And if they ask you what's next, say the feast is here
    Let them know I'm far from done!

    Writer(s): Falz.

    All lyrical content displayed on this website is the intellectual property of its respective copyright holders. No ownership is implied, and no copyright infringement is intended.

    Get the Latest Lyrics Updates!

    Subscribe now and never miss a new song lyric update.

    Failed to load audio, please try again later.
    Failed to load song data.
    Invalid email address entered!
    Enter your suggestion!
    Thanks for your suggestion!
    Link copied
    Stop & exit Playlist

    Suggest a Lyrics Edit

    Stop Song
    Rhyto-Artwork

    Story Time

    Rhyto
    × Add Rhyto to your Home Screen!